Burkina Faso dey target journalists, political opponents and odas critics for exile - report

Published 41 minutes wey don pass

Read am in 3 mins

Burkina Faso military govment dey pursue journalists, activists and political opponents wey rn comot from di kontri, Human Rights Watch (HRW) tok.

Di rights group say di authorities don issue international arrest warrant and request di extradition of dozens of pipo wey dey live abroad.

Burkina Faso Prosecutor General, Désiré Sawadogo, announce on 13 November say special court wey dey handle terrorism cases don open six cases against at least 45 pipo and organisations.

Burkina Faso send arrest warrants, who dey targetted?

Pipo wey dem target include journalists Ahmed Newton Barry, Issaka Lingani, Inoussa Ouédraogo, Adama Ouedraogo and Abdoulaye Barry, social media activist Naïm Touré and former foreign affairs minister Alpha Barry. International journalist Wassim Nasr dey among di pipo wey dem name too.

Dem accuse dem of different offences, including connection wit armed group dem wey dey fight violently and "financing terrorism".

Sawadogo say Burkina Faso don send international arrest warrants and extradition requests go Ivory Coast, France and United States.

E also say govment don ask US make dem work wit Meta to identify and prosecute pipo wey dey manage Facebook pages wey dem accuse of promoting terrorism.

Human Rights Watch say dis move na part of wider crackdown against pipo wey dey criticise military govment or report abuses wey govment forces dey commit.

"Authorities dey use counterterrorism laws target pipo wey dey criticise dem and restrict independent reporting about military abuses," di organisation talk.

E say di extradition requests fit put pipo wey run comot from di kontri at risk of arrest and possible maltreatment if dem return dem.

"Di extradition requests extend political repression beyond Burkina Faso borders, dey put critics wey seek protection abroad at risk of arrest, forced return and further abuse."

Concern about Burkina Faso death penalty

Di group express concern too about Burkina Faso recent decision to bring back death penalty for offences wey include terrorism, treason and espionage.

Since military govment seize power for September 2022, dem don accuse am of restricting media, suspending trade unions and civil society groups, and dissolving political parties.

Reports also dey about forced disappearance of pipo and forced recruitment of government critics into armed forces.

Burkina Faso dey fight Islamist armed groups since 2017. Di conflict also involve abuses by govment forces and militias wey dey work wit dem.

HRW say all sides don commit serious violations, including possible war crimes and crimes against humanity, but accountability dey very low.